President Tinubu don move Abubakar Momoh, Adegboyega Oyetola, Tunji-Ojo, and odas go different ministries.

August 21, 2023


President Bola Tinubu don move ex-Governor of Osun State and minister-designate, Adegboyega Oyetola, from Ministry of Transportation go Ministry of Marine and Blue Economy.

The President still carry another minister-designate, Abubakar Momoh, wey dey Federal Ministry of Youth, go Federal Ministry of Niger Delta Development.

Presidential spokesman, Ajuri Ngelale, talk for one statement wey e drop on Sunday night say, Federal Ministry of Youth go get new Minister-Designate soon.”

The statement from the presidency still talk say, the changes don start from now now.

According to Ngelale, President Tinubu don move minister-designate, Bunmi Tunji-Ojo, go Ministry of Interior, and Sa’idu Alkali don dey new Minister of Transportation. The Ministers of State for Oil & Gas sector come dey Federal Ministry of Petroleum Resources.

Last week, the President bin share portfolios give the 45 ministers-designate wey dem appoint, and e still keep Minister of Environment and Ecological Management give Kaduna State.

More Posts