President Bola Tinubu don leave Abuja waka go Dubai, United Arab Emirates, for COP28 Climate Summit. E go yarn for World Leaders’ Summit on December 1 and 2, 2023, talk about Nigeria matter on renewable energy and climate financing. The man go also use the chance beg for support for developing countries, talk say make developed countries bring the $100 billion wey dem talk since to tackle climate wahala for developing places. Him message go touch how businesses and institutions fit dey responsible for climate mata.
Nigeria delegation go also yan about new partnerships for Nigeria Energy Transition, Article 6 Projects, ITMOs, Technology Transfer, Capacity Building, and Methane Mitigation.
While President dey Dubai, e go join key events to attract foreign investment and also attend events by the Nigerian delegation. Ajuri Ngelale, wey be the President media aide talk say, President go return to Abuja when the summit end.