President Bola Tinubu don give command to Ministers make dem ensure say dem transform di economy and make life beta for Nigerians without any plenty talk or excuse. Di President wey give dis order during di Inaugural Federal Executive Council (FEC) meeting wey happun yesterday, come tell di new council members make dem set development targets based on di eight priority areas of im renewed hope agenda.
As dem dey yarn press people after di FEC meeting, di Ministers for Industry, Trade, and Investment, Doris Uzoka-Anite, Abubakar Kyari-Minister of Agriculture and Rural Development and others, under di leadership of di Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, don assure say very soon, the government impact go dey show for di whole country. The council also check di President eight-point agenda wey include national security, economy, agriculture, power, oil and gas, transportation, education, healthcare, di Digital economy, Women Empowerment and Judicial Reform, and other important matter.