President Bola Tinubu has signed the amended Student Loan Bill into law after it was passed by the House of Representatives and the Senate.

President Bola Tinubu don sign Amended Student Loan Bill into law

April 4, 2024

President Bola Tinubu don sign di amended Student Loan Bill into law afta e pass through di House of Representatives and di Senate.

Di bill wey dem call; “Student Loans (Access to Higher Education) Act (Repeal and Re-Enactment) Bill 2024” don be law now afta President Tinubu sign am yesterday for di Presidential Villa, Abuja and members of di National Assembly, ministers, and major education stakeholders dey present for di signing ceremony.

As e tok for di signing ceremony, President Tinubu hail members of di National Assembly for how dem take quickly consider and pass di bill, e still talk say im government dey determine to make sure say education for di kontri dey high for di list of important things, including skills development programmes.

Our reporter, Raliat Adenekan, yan say di executive bill set up di Nigerian Education Loan Fund as one kain body wey go manage and invest funds to provide loans to Nigerians wey wan go higher education, vocational training and skills acquisition programs.

More Posts