Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Presidency Don Tok Say Dem No Dey Increase Fuel Price, Dem Still Match Leg For Ground Say Dem No Dey Change The Free Trade Policy.

August 16, 2023

The Presidency don talk say dem no go increase di price of Premium Motor Spirit (PMS) wey dey di petrol stations for di whole country, as di tori wey dey fly for media bin talk. Dem yan dis one as dem dey yan State House Correspondents for di Presidential Villa for Abuja, and di Special Adviser on Media and Publicity, Mr Ajuri Ngelale, bin follow yan. E talk say President Bola Tinubu don promise say e go address di wahala wey dey for di supply, demand, and distribution of PMS for di downstream sector, as prices of crude oil and foreign exchange still dey rise. Our tori person, Raliat Adenekan, talk say di Presidential Spokesman con yan sey e no happy with di way Labour Union dey complain and dey yan say dem go do serious strike if dem increase di price, when dem never even research or confam di tori well. Ajuri still yan say di policy wey dem call Petroleum Deregulation still dey. E con show graphics of PMS pump prices for West Africa and e con beg Nigerians make dem get patience as government dey try make life beta.

More Posts