Presidency Don Name Chisco, GIG And Odas As Transport Companies Wey Go Chook Hand For The Christmas Season Transport Money Wey Dem Wan Slash. 

December 22, 2023

Presido don yan di COMPANIES wey go enta di 50 percent slash of Inter-state transport fares wey im approve. For one post wey dem do yesterday, Special Adviser to di Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga talk say GIG (God is Good), Chisco Transport, Young Shall Grow God Bless Eze-nwata, and Area Motors dey among.
Presido Tinubu bin approve di reduction plus “free train rides” for Nigerians from today, Thursday, December 21, 2023, to January 4, 2024. Chairman of di Inter-Ministerial Committee on Presidential Intervention, Dele Alake, talk am on behalf of Presido.
As part of di package, government still add 35,000 naira pay increase every month for six months for federal workers, plus dem suspend VAT on diesel and social security cash transfers go reach di poorest Nigerians.

More Posts