President Muhammadu Buhari don draw hand for ear warn ministers, permanent secretaries, and heads of government agencies say make dem no leave dia work becos of election runs.
Na for Abuja he warn dis warning so on Tuesday for the closing ceremony of the 2022 Ministerial Performance Review Retreat, as he tok say anybody wey do dat kain tin ehn, dem no go take am play with dat person
Oga Presido Buhari yarn say, as campaigns for next year elections don start, nobody sopos leave him work becos of the election.