
8 July 2025
Police don begin investigate di fire incident wey lead to di death of 29 year old Sunny Amadi for Choba, Rivers State
Pipo shock wen tori burst say Sunny Amadi die from severe burn wey e suffer from di fire im supposed girlfriend allegedly cause.
BBC Pidgin gada from a relative of di girlfriend say di incident hapun for Ogbogoro road for Choba, near di University of Port Harcourt campus for di girlfriend off-camp apartment, and e leave her in a condition wey dey very severe as she sef suffer serious burn injuries.
“According to wetin she tell us, on di day di tin happen, she bin comot go buy somtin. Wen she return she see say candle dey on for her house.
“She surprise becos though light bin no dey, she no light any candle for her house. Wen she reach she she her former boyfriend inside di house wit a gallon of fuel.”
Di relative explain say she and di boyfriend bin don break up and she don tell am make e no call her or come near her again, but e dey beg her but she no gree.
“E say dem come begin argue as she tell am to comot from her house and in di process di fuel come pour and catch fire from di candle na so di fire burst cover di two of dem.
“So she try run comot from di house but already di fire don also burn her bodi.
“Na one neighbour call me say make I come see wetin don hapun, na so I rush come from village amd we carry dem go hospital.
“Unfortunately di boyfriend don die from di injuries wey e get but she sef dey critical condition too as she suffer second degree burns wey cover her bodi.”