Former presidential candidate and leader of the Nigeria Democratic Congress, Peter Obi, don talk say e fit no dey alive to contest the 2027 presidential election, as e accuse government of frustrating am and other opposition members.
Obi yarn this one during interview with Chude Jideonwo for With Chude programme.
According to am, every move wey e dey make, government agents dey allegedly block am, adding say if dem get chance, e fit no even survive reach 2027.
“I fit no even dey alive. Every single thing wey I dey do, dem dey frustrate am,” Obi talk.
The former Anambra governor say the alleged attacks no be only against am, but against plenty opposition figures across the country.
Obi also claim say airport officials once lock him car while other vehicles wey park for the same area no get any problem. He further talk say some people now dey avoid greeting am publicly because dem fear say authorities fit target dem.
He even allege say some supporters don beg am not to attend their family events, including weddings, because of fear of possible consequences.
As at the time of this report, Federal Government never respond to Obi’s allegations, and Obi no provide any evidence to support the claims.




