Comfort Emmanson, the passenger wey beat airline staff for Ibom Air flight from Uyo to Lagos, don face court and dem don remand her for Kirikiri Correctional Centre for Lagos.
Tunde Moshood, wey be Special Adviser on Media and Communications to the Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, confirm the matter for him official X handle on Monday.
He write say, βNa why people wey dey fly suppose dey behave well. That unruly passenger wey dey Ibom Air from Uyo to Lagos, Miss Comfort Emmanson, don go court and she dey cool body now for Kirikiri.β
This one dey happen as Nigeria Civil Aviation Authority don warn say dem go begin take strong action against passengers wey dey misbehave, as the wahala don dey increase for Nigerian airports.
Comfort Emmanson, wey dey inside Ibom Air flight from Uyo to Lagos, slap one Purser for the aircraft multiple times for one viral video. Dem talk say she vex because dem tell her make she off her phone before take-off.
Ibom Air come release statement on Monday say dem don ban the passenger from flying with their airline after she assault one of their crew members.
Dem explain say the wahala start before take-off from Uyo when Emmanson refuse to follow safety rules wey talk say passengers must off their phone. One passenger wey sit near her off the phone, and na there the shouting start.
When the plane reach Lagos, Emmanson confront the Purser wey first tell her to off her phone, and she beat am.
Ibom Air talk say she even try remove fire extinguisher to use as weapon, and dem describe that act as attempt to damage and ground the aircraft.
Dem talk say her behavior be serious threat to the safety of crew, passengers and the aircraft itself.
This matter happen shortly after another incident wey involve Fuji musician King Wasiu Ayinde Marshal, aka KWAM 1, wey try stop ValueJet plane from take off after dem don comot am from the flight.