One human rights group wey dem dey call International Society for Civil Liberties and Rule of Law (Intersociety) don talk say over 22 terror groups dey inside Nigeria now, and dem dey scatter peace for the country.
Dem talk say most of these groups na foreign Islamic bandits wey dey target Christian areas, and dem plan to wipe Christians comot from Nigeria. Intersociety talk say these groups dey use Nigeria as safe place, and dem dey work to finish about 112 million Christians and 13 million people wey dey follow traditional religion, especially for South East, South-South and North Central.
The chairman of Intersociety, Emeka Umeagbalasi, talk say the groups don kill 7,087 Christians and kidnap 7,800 people within 220 days for 2025. Dem also kill thousands of liberal Muslims for some parts of the North. Altogether, dem don kill 185,009 innocent Nigerians.
Dem force millions of Christians to run comot from their homes, turn IDPs. Intersociety talk say these terror groups dey use violence and genocide to try wipe out Nigeria indigenous tribes and their culture.
Dem talk say the 22 terror groups dey operate freely and dem suspect say some people for government dey protect them. Dem wan turn Nigeria to place wey Christianity go dey banned and crushed.
Their study show say over 19,100 churches don suffer attack, burn or destruction. The number still dey grow. Dem also talk say over 500 Christian pastors don suffer attack and kidnap in the past 16 years, including 160 Catholic priests and 11 wey dem kill, among them seminarians from 2015 reach August 10, 2025.
Dem talk say no less than 1,100 Christian communities, especially for Northern Nigeria, don suffer attack from Islamic jihadist groups. Di ancestral lands wey belong to these communities, about 20,000 square miles, don dey taken over and occupied by di attackers.
States wey suffer pass na Plateau, Benue, Niger, and Southern Kaduna, among others.