Olubadan of Ibadan Oba Olakulehin don die at di age of 90

July 10, 2025

Oba Owolabi Olakulehin

7 July 2025

Di Olubadan of Ibadanland, Oba Owolabi Olakulehin, don go join im ancestors.

E die at di age of 90 as celebrations for im 90th birthday and di first anniversary of im reign as Olubadan of Ibadan land bin dey hapun.

Owolabi Olakulehin, passed away in the early hours of Monday, July 7, 2025, one year afta e ascend di throne.

Di late Olakulehin become di 43rd Olubadan for 2024, after e take over from Oba Lekan Balogun. Na Oyo State Govnor Seyi Makinde give am di staff of office.

Mr. Toye Arulogun, one of the members of di Olubadan Media Team wey confam di development to tori pipo for Ibadan say, ”I fit confam am. We go soon issue official statement on am”, Arulogun, wey be one time Commissioner for Information for Oyo State, tok.

Former Oyo State Govnor, Rashidi Adewolu Ladoja, na next in line to di throne.

Tins to know about di late Oba Owolabi Olakulehin

Oba Owolabi Olakulehin

Dem born Oba Olakulehin on July 5, 1935 for Okugbaja village, Abari Bale for north-eastern area of Ibadan.

Im parents na Pa Ishola-Okin Owolabi, and Adunola Aweni Ope Ajilaran Omoyoade Owolabi.

Olakulehin bin start im education for St James Primary School, Oke Akaran, e later go Islamic School, and e finish for St Peter Primary School, Aremo, Ibadan.

Di late Olubadan bin work as teacher for Wakajaye primary school Akobo Ibadan and later proceed to Yaba Technical Institute.

For 1959, Owolabi Olakulehin begin work for Ministry of Works, Western Region Govment for Ibadan.

Afta den e proceed to Yaba College of Technology wia e kollet OND ati HND certificate.

In 1970 e bin join di Nigerian Army as 2nd Lieutenant, e later become Major, and e work for different department of di army bifor e retire for 1st of October 1979.

Olakulehin bin begin some private companies afta e comot for di army.

Some of di companies na FAKOL Nigeria Ltd, Olakulehin Press, (wey later become Solid Prints) and FAKOL Bakery for Ibadan.

Owolabi Olakulehin later join politics and e contest for di position of Representative under Social Democratic Party (SDP) for 1992, wia e bin represent Ibadan East for di House of Representatives.

Olakulehin journey to di throne of Olubadan bin start for 1983 afta e bin hold title of di head of family. E bin dey in line for 41 years bifor e later become king.

Di Obaship tradition for Ibadan get one succession plan wey allow make all ruling families get dia Migaji to wait in line till e reach dia turn.

Dat na why most of di Olubadans dey need wait for long bifor dem later dey crowned.

Im family house na Ige Olakulehin Ita-Baale Olugbode, Ibadan.

E bin hold di position till e become di Balogun of Ibadan, one of di most prominent position for Ibadan.

Na for 12th of July 2024 Owolabi Olakulehin receive staff of office as di Olubadan of Ibadan.

Na Oyo State Govnor, Seyi Makinde, bin present am wit di staff of office on July 12, 2024, to make am di 43rd Olubadan of Ibadanland.

E bin just celebrate im 90th birthday and preparation bin dey go on for im 1st anniversary for di throne bifor e die.

Oba Olakulehin ascend di throne afta di death of Oba Lekan Balogun, Alli Okunmade II, wey die at di age of 81 on March 14, 2024.

More Posts