Obi, Atiku Don File “I No Gree” Case For Supreme Court, Both Of Dem Dey Find Way As To Cancel The Presidential Election Committee Judgement.

September 20, 2023

Presido Candidate of PDP, Atiku, don appeal di tribunal judgment wey talk say Tinubu win di election. Atiku talk say tribunal make serious mistake when dem no cancel di election.
Also, Labour Party Presido Candidate, Peter Obi, don file 51 grounds of appeal for Supreme Court to cancel di judgment wey talk say Tinubu win di election. Obi talk say tribunal no follow justice when dem talk say e no specify where bad tin happen for polling units during di election, plus dem throw away im witnesses’ evidence.

More Posts