Nigerian Police Command fit to invite music star BNXN very soon to ask am some kain question he boast say he pour spit ontop one police officer for inside tweet wey he don now delete.
According to the toktok person of the Lagos State Police Command, Benjamin Hundeyin, wey reacted ontop him Twitter page on Wednesday, August 17, 2022.
The music star been dey involved serious argument with Police pipo on Wednesday afternoon, and for inside dat video wey don go viral, dem don almost comot the shirt finish when he dey challenge Police officers wey block block him car.
Hundeyin react to BNXN tweet note say dem go sanction the police officers if dem confam say dem misbehave true true, while BNXN go surely answer question for him assault on a police officer.