NNPC Don Confam Say we Get Enough Fuel For The Next 30-DayAnd Also Dey Advise Pipo Make Dem No Use Fear Do Panic Buying.

October 20, 2023

The Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Limited don tok say the plenty line up of fuel for some parts of Lagos and a few oda locations around the country na because dem don reduce Warehouse loadout for Apapa, Lagos for some days now. But the NNPC management for one statement yesterday con also dey advise pipo wey get motor and those wey wan buy fuel say make dem dey careful so dem no go use fear buy bad market as distribution of fuel go normalize back over the next few days. The last time we get dis kain line ups for filling stations wey we no fit forget na for May after President Bola Tinubu carry mic yarn us say dem don comot fuel *shock money* during him swearing in. The announcement con lead to lack of fuel that period wey con dey cause long-long line ups for filling stations round we country that time.

More Posts