Nigeria and South Africa don renew dia commitment to strengthen dia long-standing relationship and boost economic integration.
For di opening of di 11th session of di Nigeria-South Africa Bi-National Commission for Cape Town, President Bola Tinubu talk say Africa need unity of purpose and call for di creation of an Anti-Illegal Mining group to fight di illegal mining wey dey impoverish African countries.
Our correspondent, Raliat Adenekan, report say President Tinubu urge di leaders of di two countries to commit to di decisions dem don make, work together for areas like investment, empowerment, and support di talented youths of di two nations.
To improve trade between di two countries, President Cyril Ramaphosa talk say e go push make Nigerian products dey fill South African shop shelves. E also promise to grant legit Nigerian business people five-year multiple-entry visa and allow Nigerian tourists apply for visa without submitting dia passport.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/fg-don-protest-di-probe-wey-di-nigerian-army-dey-face-for-icc/