Di Nigeria Football Federation (NFF) don name two new players wey go join di Super Eagles squad ahead of two friendly matches wey dem go play for March.
Di new players na defender Gabriel Osho wey dey based for England, and Benjamin Tianimu wey dey based for Tanzania. Dis go be di first time wey dem go join di team.
Nigeria go play against Ghana for March 22 and Les Aigles of Mali for March 26, for two top-grade friendly matches for di Moroccan city of Marrakech dis month.
Di statement from Ademola Olajire, NFF Director of Communications, tok say Nigeria retain di bulk of di squad wey finish as runners-up for di 34th Africa Cup of Nations for Cote d’Ivoire.