Farhan Hasan just finish exam and dey comot classroom dey gist wit im friends wen one Bangladeshi Air Force training jet crash enter im school campus – kill at least 27 pipo.
“Di burning plane bin dey hit di building right in front of my eyes” di Milestone School and College student tok.
Video from di school for one northern suburb of di capital, Dhaka show one big fire and thick smoke, afta di aircraft jam one two-storey building.
27 pipo die and more dan 170 pipo injure for di crash.
Di armed forces tok say di F-7 jet get mechanical fault afta e take off for training exercise just afta 13:00 local time (07:00 GMT). Di pilot, Flight Lieutenant Md. Taukir Islam, dey among di pipo wey die.
Farhan, wey bin dey tok wit im uncle and im papa, add say, “my best friend, di one wey I dey exam hall wit, e die right in front of my eyes.
“For my eyes… di plane pass right over im head. And many parents bin dey stand inside sake of di younger pikins dey come out since e be say na end of school day… di plane carry di parents along wit am.”
One teacher for di college, Rezaul Islam, tok say e see di plane “directly” hit di building.
Anoda teacher, Masud Tarik, tell Reuters say e hear explosion, “wen I look back, I only see fire and smoke… Plenty guardians and pikins dey here.”
Hours afta di crash, for one residential area wey dey very populated, big crowd gada wit pipo wey stand on top buildings to see wetin happun.
As pipo dey run for all directions, ambulances and volunteers dey try find dia way to carry di injured and plenty bodies comot from di Milestone School and College.
At least 30 ambulances bin dey move pipo comot.
One woman wey bin dey find informantion for di scene tok say her son call her afta di crash hapun, but she never hear from am since den.
More dan 50 pipo, including children and adults, dey hospital wit burns, one doctor for di National Institute of Burn and Plastic Surgery tok.
Plenty families and relatives of di victims dey inside hospital – including Shah Alam, wey be uncle to one Year 8 boy, Tanvir Ahmed, wey die for di accident.
“Na my pikin-pikin dey for mortuary now” Mr Alam tok as e dey hold im younger broda – Tanvir papa wey no fit tok anytin.
Most of di victims wey dey inside di burns hospital na small pikin dem – most of dem dey between nine and 14 years old.
No be only di burns hospital dem carry injured pipo go. Bangladesh health ministry tok say seven hospitals for di city dey treat victims.
Di kind accident wey happun don make many pipo for town begin come out to donate blood, and even politicians from two of di biggest parties for di country Bangladesh Nationalist Party (BNP) and Jamaat-e-Islami don go visit di injured.
Meanwhile, dem don declare Tuesday as day of mourning – and di national flag go dey fly half-mast.
Di training aircraft take off from Bangladesh Air Force Base for Dhaka around 13:00 local time (07:00 GMT) and e crash soon afta for di Uttara neighbourhood.
Di air force tok for one statement say di F-7 jet get mechanical fault and di pilot, Flight Lieutenant Md. Taukir Islam, try to fly am go a less crowded area. E dey among di pipo wey die.
Images from di scene hours afta di crash show plenty emergency service workers dey go through burnt remains to find survivors.
Authorities don put togeda one investigation committee to look into di incident, di armed forces tok for statement.