Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

We Go Follow lawyer Talk Before We Answer C Ronaldo – ManU

November 15, 2022

Manchester United go get lawyer advice before dem plan how to answer to Cristiano Ronaldo shocking interview talk. For Ronaldo talk-talk with TalkTV , wey Sun produce on Sunday evening, you go see the 37-year-old dey lambast the club and manager Erik ten Hag, say hin no get respect for the manager. The footballer talk say hin feel say Manchester United don stab am for back because dem dey try force am comot the club, hin con also dey claim say the club don make “otoine progress” since Sir Alex Ferguson stop work for 2013. Hin also talk say the pipo wey get the club ‘The Glazer Family’ no really send the club papa for the sporting side.

The club hear dis matter of dis interview as dem dey ready fly back from London on Sunday evening after deir 2-1 win over Fulham.  Senior pipo for the club dey hold talk on how dem go treat the player misbehaving.

More Posts