Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Tanzania's Minister sacked over election rigging comments

Tanzania Minister don chop sack relate to election rigging.

July 23, 2024

Tanzania Information Minister, Nape Nnauye, don lose im job after im talk wey suggest say election fit be rigged cause public outcry. Dem film Nnauye for one rally on July 15, where im talk say im go help one ruling party Member of Parliament win for di 2025 election.

After di video wey show im controversial remarks scatter for social media and people react, Nnauye talk say im just dey joke.

But President Samia Hassan come sack am from di cabinet as part of one big reshuffle, but dem no talk di reason for why dem take dis decision.

READV MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/58-more-nigerians-wey-dem-traffic-don-rescue-for-ghana/

More Posts