Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Super Falcons don seal qualification for Nations Cup afta dem win against Cape Verde.

December 6, 2023

Super Falcons don qualify for Women’s Africa Cup of Nations next year afta dem beat Cape Verde 2-1 for Estádio Nacional de Cabo Verde for Praia. For di reverse fixture wey dem play for Moshood Abiola Stadium for Abuja last Thursday, Nigerian ladies win 5-0. Cape Verde first score for di 8th minute with Ivania Moreira goal. Esther Okoronkwo and Acting captain Rasheedat Ajibade come score for Nigeria to secure dem place for di competition.

More Posts