Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

The Nigerian U15 boys Future Eagles don hit snag for dia quest to participate for di UEFA U-16 development tournament for Spain as di Spanish Embassy don deny dem visa.

Spain don deny Nigeria U-15 team visa for UEFA U-16 tournament

April 9, 2024

The Nigerian U15 boys Future Eagles don hit snag for dia quest to participate for di UEFA U-16 development tournament for Spain as di Spanish Embassy don deny dem visa.

Di Nigeria Football Federation (NFF) announce dis tori for one post on X on Monday.

Di players and officials suppose fly enter Spain on Tuesday afternoon for di tournament wey di African giants bin dey invited to. No reason bin dey given for why dem deny di team visa.

According to NFF, di special invitation for di tournament happen sake of Nigeria’s achievements for youth football, where dem don win five world titles for U17 boys level and reach FIFA World Cup final two times for U20 level.

More Posts