Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

SA Court Don Order Zuma To Go Back Prison

November 23, 2022

South Africa Supreme Court of Appeal don order before President Jacob Zuma make hin go back prison after dem support one ruling say hin medical supervision dey illegal. Dem give the 80- year old one 15-months sentence last year unto say hin disrespect the court as eh no gree give evidence during one torchlighting  inside corruption, but con release am after hin spend two months for jail, after hin lawyers drag say hin get sickness wey fit cause hin death but dem no gree mention the kin sickness. For inside judgement on Monday wey all of dem agree on, the judges con talk say make the prison authorities decide weta dem go count  the time the before president illegally spend out of prison to hin sentence or not.

More Posts