Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

President Tinubu talk say people wey dey sponsor planned protest put their own selfish ambition above the national interest.

July 26, 2024

President Bola Tinubu don calm people mind say no interest group fit manipulate the ongoing economic reforms. He talk say his campaign na self-sponsored, without any string or debt to any person or institution.

The President yarn this one yesterday when he receive a delegation of Islamic leaders for the State House wey Sheikh Bala Lau lead. He talk say his victory for the election last year na by divine intervention, careful planning, and the support wey he get from Nigerians.

On top the planned protest, President Tinubu talk say the sponsors dey put their selfish ambitions above national interest. He warn say protests wey dey fueled by anger and hate fit turn violent and take the country back.

Earlier, President Tinubu don meet with prominent royal fathers wey Sultan of Sokoto, Muhammad Sa’ad Abubakar III, and the Ooni of Ife, Adeyeye Ogunwusi, lead. Dem brief am about government policies and programmes. The Ooni come beg those wey dey plan the nationwide protest make dem give government chance to address their issues.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/federal-government-don-cut-allowances-of-stranded-foreign-scholars/

More Posts