Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

President Tinubu don set up National Single Window Project Committee to make import and export activities easy

April 17, 2024

President Bola Tinubu on Tuesday launch di National Single Window initiative, one transformative project wey go push di nation economy go new levels.

Di initiative na anoda bold testament to di President commitment to break long-standing developmental barriers to advance di progress, prosperity, and well-being of every Nigerian.

As e dey speak for di launch of di initiative for di State House, President Tinubu talk say di National Single Window na game-changer wey go revolutionize di way trade dey happen for di country, and wit di Office of di President dey oversee di steering committee wey go drive di reform process forward.

President outline di benefits of di initiative, tok say by simplifying government trade compliance through digital platform, Nigeria go unlock di doors to economic prosperity, add say: “Dis initiative go connect our ports, government agencies, and key stakeholders, create one seamless and efficient system wey go facilitate trade like never before.”

Di President still explain say paperless trade alone go bring annual economic benefit of around $2.7 billion, note say countries like Singapore, South Korea, Kenya, and Saudi Arabia don already see significant improvements in trade efficiency afta dem implement Single Window systems.

President Tinubu emphasize say di implementation of di National Single Window no go happen overnight as e go need dedication, collaboration, and phased approach sake of di continental ramifications wey extend far beyond national development imperatives alone.

More Posts