Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Petroleum Retail Outlet Owners talk say fuel scarcity dey happen because NNPC no dey supply dem enough

April 30, 2024

The wahala with Premium Motor Spirit (PMS) wey people dey call petrol still dey hot as di country dey face fresh gbas-gbos of fuel scarcity, even as NNPC Limited don talk say dem don resolve di cause of fuel scarcity for di country.

NNPC spokesman Olufemi Soneye bin tok for one statement last week say di prices of petroleum products no dey change, while e still explain say di wahala of scarcity na because of logistic kasala wey don already find solution.

But di Petroleum Product Retails Outlet Owners Association of Nigeria don talk say one of di reasons why fuel scarcity and long queues still dey for filling stations across di country na because dem no fit get access to fuel supply from loading depots wey NNPC Limited dey manage.

Mr. Billy Grillis-Harry, wey be di National President of di association, for one interview wey our correspondent monitor, explain say NNPC dey work round di clock to ensure say dem dey supply enough fuel, and e clear di rumor say federal government still dey pay subsidy on top fuel products.

More Posts