Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Federal Government don roll out designs for more federal roads

April 30, 2024

Minista of works, David Umahi, don talk say di Lagos/Calabar Coastal Highway dey expected to circle di entire Nigeria based on additional road design proposal wey go dey presented before di Federal Executive Council.


Umahi yan dis one for Eleko Lagos, afta im finish inspection of Section one of phase one of di coastal highway project, talk say di federal government no dey plan to increase di budget wey dem allocate for di project execution, even as dem don make plenty adjustments.


According to di minista, di President don give am approval to design di one thousand kilometre Sokoto/Badagry highway to be part of di ongoing coastal road, while anoda part, na di Enugu/Abakaliki/Ogoja road wey go reach Cameroon, wey be about three hundred and sixty one kilometres.

More Posts