Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

PDP Governors don tell Federal Government say make dem Address di Insecurity and Economic Wahala wey dey ground

February 13, 2024

Governors wey enter office under the Peoples Democratic Party (PDP), talk again on Monday say dem still believe say state policing na di solution to the bad security situation wey dey Nigeria.

Governor Bala Mohammed, wey be the Chairman of the Forum and also Governor for Bauchi State, yarn dis one when he talk to journalists after dem hold meeting for Abuja.

Governor Mohammed also talk say the governors still complain about how naira dey fall anyhow and the wahala wey dey come with am. Dem come talk say make the Federal Government’s economic team find better solutions to this wahala.

E still talk say the cost of living for the country too high, and the value of naira don drop. E talk say Nigeria dey almost waka enta the same road wey Venezuela waka, and Venezuela dey suffer for bad economic and security wahala.

The Forum come tell the Federal Government say make dem, as a serious matter, start initiatives wey go involve all the state governments to find solution wey go last for this wahala.

More Posts