Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

NRC Don Close Down Deir Ekehen Station After Attack & Kidnapping

January 10, 2023

The Nigerian Railway Corporation (NRC) don carry mic yarn us say dem don close down deir Ekehen Station for Edo State until 19gboro, after the attack and kidnapping of passengers wey happen not too long ago for the Igueben train station by kidnappers wey carry AK 47.

Na the Edo State Olopa Public Relations Officer, Chidi Nwabuzor confam dis tori for statement wey him drop, where him talk say the attack happen on Saturday evening and e also make plenty pipo carry wound for body. If we remember, dis attack dey happen just 10 months after one close accident happen wey some terrorist attack one Kaduna train wey dey milate from Abuja and dem also report losses and many passengers wey dem kidnap.

But the olopa authorities for one statement con dey yarn Nigerians make dem no fear as the olopa officers don dey follow the kidnappers for back and the goal na to rescue all the pipo the kidnapers keep for dea hide-out.

More Posts