Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

NPFL reschedules all Match Day 28 fixtures to April 3

NPFL don reschedule all Match Day 28 fixtures to April 3rd

March 28, 2024

All di 10 Match Day 28 fixtures for di ongoing 2023/2024 Nigeria Premier Football League (NPFL) go happen on April 3, instead of dis weekend as earlier planned.

Di Chief Operating Officer (COO) of NPFL, Davidson Owumi, for one letter wey e write on Wednesday, talk say di change of date happen because of di state final matches wey go happen dis weekend for di 2024 Federation Cup competition.

Di matches bin don move go April 2 because of di Easter holidays and di Federation Cup matches, but dem don rearrange am again for Wednesday, April 3, because of logistics wey involve NPFL teams.

More Posts