Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

NNPC Don Talk Say Dem No Get Plans To Increase Price Of Fuel For We Country

February 9, 2024

The Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Limited don talk say dem no get any plans to increase the price wey dem dey sell petrol, wey be premium motor spirit.

Dem yarn for one statement wey the spokesman of NNPC Limited, Mr Olufemi Soneye, release. The statement come assure consumers say no be now dem go increase the cost of petrol, even as queues dey increase for filling stations.

Dem come add for the statement say make motorists for the whole country no go start to do panic buying.

More Posts