Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Lagos Civil Servants Go Start To Dey Work From Office Three Days Per Week To Take Reduce The Economic Hardship Inside The State

February 23, 2024

Governor Babajide Sanwo-Olu don announce say civil servants for Lagos State wey dey Level 1 to 14 go dey come work physically three times for one week and work virtually for the remaining two days.

E talk say dis one go help reduce economic wahala for the state. The governor talk dis one for media chat wey happen on Thursday.

Governor Sanwo-Olu also talk say dem go reduce public transportation cost for the state by 25%. E still announce free child delivery package for pregnant women for different health facilities for Lagos.

The governor also talk say dem dey think about partnering with food vendors for different local governments. The vendors go provide daily meals for residents.

More Posts