Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

he Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB), says it uncovered over 1,665 fake A’level results during the 2023 Direct Entry (DE) registration exercise

JAMB don discover 1,665 fake A-level results during Direct Entry registration

April 3, 2024

JAMB Registrar, Prof. Is-haq Oloyede, don talk say dem uncover over 1,665 fake A’level results during di 2023 Direct Entry (DE) registration exercise.

Oloyede wey disclose dis, say out of di figure, “397 na from Colleges of Education, 453 from University diplomas, and di rest na from other A’level certificates.”

For di weekly bulletin wey dem release yesterday, di registrar recall say for di past, when candidate apply for DE, di Board go just ask awarding institutions to do di necessary screening and due diligence.

Oloyede come talk say out of 148 Direct Entry applications to di Bayero University, Kano (BUK), only six of di certificates wey dem send for processing na genuine. Dis discovery of di big fraud make dem gather stakeholders wey go meet to find ways to fight dis wahala.

More Posts