Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Israel dey investigate claims say share traders sabi before hand about di Hamas attack

December 6, 2023

Israel dey investigate claims say some investors fit don sabi about di attack wey Hamas go do for Israel before e happen on October 7. One academic study talk say investors wey dey bet against Israel economy fit don make plenty money based on di attack. Dem find out say plenty short-selling happen before di attacks. Short-selling be when investors dey try make money from shares or bonds wey dem believe say e go fall in price. Dem go arrange to sell shares wey dem never get at di current price, dey hope say dem go fit buy am later at a cheaper price before di shares change hand, so dem go fit collect the difference.

More Posts