Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Ghana Pres. Don Fire Ein Junior Finance Minister

November 15, 2022

Ghana President Nana Akufo-Addo don fire hin junior finance minister, Mr Charles Adu Boahen, on to say dem point finger give am for one documentary on top illegal gold mining wey go happen soon, say ehn go shook hand inside bad things. Na Anas Aremeyaw Anas make the documentary and dem call am “Galamsey Economy”, Anas film before don make FIFA ban the former Ghana Football Association President and punish over 50 referees for round Africa. Anas don also torchlight the country legal system wey make dem comot over 30 senior and lower court judges for Ghana on top say dem dey collect envelope money to drop cases. Small expo from the documentary show pictures of Boahen dey try demand $200,000 from future investors to take give the Vice President, Mahamudu Bawumia so eh go fit allow dem do business. The Vice President don since deny say eh no sabi anything for inside the wayo deal.

More Posts