Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Federal Government dey plan to share N25bn healthcare enhancement funds give states.

April 1, 2024

Federal Government don approve di disbursement of N25 billion through di Basic Health Care Provision Fund (BHCPF) to boost healthcare infrastructure for states.

Prof. Muhammed Pate, di Coordinating Minister of Health and Social Welfare, wey yan dis one for di sixth meeting of di BHCPF Ministerial Oversight Committee, talk say di money go dey used for direct facility financing and workforce incentives for states.

Di minister talk say di initiative dey follow President Bola Tinubu agenda and im commitment to improve healthcare outcomes for Nigerian women, children, and vulnerable populations.

E yan say di disbursement go happen through gateways wey include di National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA) and National Health Insurance Authority (NHIA).

More Posts