Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Fed High Court Don Cancel APC May Primaries for Akwa Ibom

November 15, 2022

The Federal High Court for Uyo, the Akwa Ibom State capital, don cancel the All Progressive Congress governorship primary wey dem do for May 26th,2022, and order make dem do fresh governorship primary under the next 14 days. The leading judge for the matter, Justice Agatha Okeke, wey deliver the judgement yesterday, November 14th,2022, also disqualify the candidate wey dey hold the governorship flag of the party against next year election, Akanimo Udofia, say eh no wan smell hin leg for the primary, because hin no be member of the APC for the state. The court also order the INEC make dem no accept Udofia as candidate according to 77 sub-section 3 of the Electoral act.

More Posts