Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

English teams don crash out of UEFA Champions League for di quarterfinals

April 18, 2024

Holders Manchester City don crash out of di Champions League afta dem lose for penalty shoot-out to Real Madrid for one epic match for Etihad Stadium.

After 1-1 draw on di night wey make di two teams tie 4-4 for aggregate, Antonio Rudiger score di winning spot-kick afta Bernardo Silva and Mateo Kovacic miss dia own attempts, so Real Madrid progress 4-3 for di shoot-out.

Elsewhere, one powerful header from Joshua Kimmich see Bayern Munich win 1-0 for dia Champions League quarter-final second leg, and dem knack Arsenal 3-2 for aggregate to knock di Gunners out of di competition.

Di return leg no too get di drama wey happun for di first match for Emirates Stadium, wey end 2-2, but di Germans take advantage of one moment of poor Arsenal defending.

Kimmich blast hin shot just after one hour to see Arsenal chop defeat, and dem suffer another blow to dia hopes of winning trophy dis season afta dem lose 2-0 to Aston Villa for di Premier League on Super Sunday.

More Posts