Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

EFCC Don Raise Special Taskforce Wey Go Fight Against Use OF Dollar For We Economy

February 8, 2024

The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don raise Special Task Force for all their Zonal Commands to enforce di existing laws wey dey against currency mutilation and dollarization for di economy.

Dem talk dis one for one statement wey dem release yesterday, and according to dem, di Task Force wey di Chairman of di Commission, Mr Ola Olukoyede inaugurate, na to protect di economy from any kind of abuse, leakages, and any kind of disruptions wey fit expose di economy to instability.

Di statement come reveal say EFCC don arrest some people wey dey do issuance of invoices with dollars and wey dey mutilate Naira for Lagos and Port Harcourt, and dem talk say dem don invite di owners of private universities and oda higher institutions wey dey charge school fees with dollars.

More Posts