Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Defence HQ Dey Find 19 Terrorists

November 15, 2022

The Defence Headquatres on Monday, drop information of 19 terrorists wey dem dey find and anybody wey fit give informat wey go help dem handcuff any of the terrorist, na one N5 million prize dey wait deir acoount to say ‘Wehdone o’. The statement declare say the 19 terrorist commanders don dey cause disaster for the North-East, North-West and North-Central areas of the country. For one statement, the Director of Defence Information, Major-General Jimmy Akpor yarn Nigerians say if anybody get important informat wey go help dem capture desepipo, make dem no waste time call the military on 09135904467. Those terrorist dem declare say dem dey find be Sani Dangote from Dumbarum village, Zurmi LGA of Zamfara State, Bello Turji ( Fakai village, Zamfara State), Leko (Katsina State), Dogo Nahali (Kankara LGA, Katsina State), Hallilu Sububu (Maradun LGA, Zamfara State) and Nagona from (Angwan Galadima of Sokoto State) and many others.

More Posts