Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

D’ Tigers camp Go Soon Open For Abidjan To Prepare For Di Window Four Ff 2023 FIBA World Cup qualifiers

August 19, 2022

The National Male Basketball team, D’ Tigers camp go open on Saturday, Aug. 20 for Abidjan to prepare for window four of the 2023 FIBA World Cup qualifiers.

Na Afolabi Oni write am for statement on behalf of the Media Committee of the Nigeria Basketball Federation (NBBF) on Thursday, wey dem quote the head coach of the team, Mike Brown, dey yarn say e become necessary to address the slow start for the first two windows when the team lose to Cape Verde.

Brown add jara say he get confidence say early preparations go make a difference when his players enter the court for dia first game.

D’ Tigers currently dey fourth ontop the table, and dem go play dia opening match against host- Cote d’Ivoire on Aug. 26, play against Guinea a day after, before dem go jam Angola on Aug. 28.

The 2023 World Cup go shele from Aug. 25 to Sept. 10 for Japan, Indonesia, and the Philippines.

More Posts