Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Chief Of Army Staff Don Match Leg For Ground Say The Sit-At-Home Order Round The South-East Don End. 

September 13, 2023

The Chief of Army Staff, Lieutenant General Taoreed Lagbaja, talk say the sit-at-home order wey Indigenous People of Biafra enforce for South-East don end. Dem bin dey do this sit-at-home to demand say dem release dia leader, Nnamdi Kanu, from prison, and e don dey affect the economy for South-East since August 2021.

Lagbaja talk dis one for di COAS combined second and third quarter’s conference for Abuja yesterday. E talk say e end because hin men bin put beta effort and work with people wey get hand for the matter. Lagbaja still talk say dem don control di wahala wey Boko Haram and oda terrorists dey cause, and people for di states wey dey get trouble don start to dey do business again.

More Posts