Naija_logo
🎧 Listen Live πŸ”΄

Live on air

CBN Say Dem Get Enough New Notes To Reach Everybody Before Jan. 31 Deadline

January 10, 2023

The Central Bank of Nigeria don match leg for ground say dem get enough new notes to waka round the country before the January 31st deadline when old notes no go dey legal for the country again.

Osita Nwanisobi, the Director of Corporate Communication, CBN yarn dis matter give us when e dey shake head deny the tori wey don get k-leg say dem no get enough new notes for banks dis weekend. According to Nwanisobi, dese k-leg tori say plenty new notes no dey ground na lie-lie talk, him talk say most of the banks still get the old notes because the notes still dey waka round and dem still remain legal.

E con dey yarn Nigerians make dem coole’ as the new notes go waka round wella but also con dey ginger the public make dem still dey use the old notes as dem still legal. If you look the matter as I don look am, many ATMs for round the country still dey drop the old N1,000, N500, and N200 notes, just four weeks before the deadline wey the top bank give.

More Posts