Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

CBN Don Start Countdown unto New Note Circulation

November 23, 2022

The Central Bank of Nigeria don start one countdown clock for deir website for the January 31st, 2023 deadline for the N200, N500, N1000 notes wey dey in use for our country. The top bank don already carry mic announce before say dem wan redo Naira policy to produce new notes for the three of the naira value wey dey in use for we country: N200, N500, N1000 notes. The CBN don set December 15th, 2022, as the official day the new naira notes go start to dey move for we country. Dem say the notes wey dey waka round now go remain legal along with the new notes from December 15th, 2022 to January 31st, 2022. The Central Bank don promise say all banks go dey operate from Monday’s to Saturday’s every week. Before,the CBN governor, Godwin Emefiele, talk say Nigerians dey hide naira notes, hin con add say mathematics don show dem say over 80% of the naira notes dey outside the vaults of the business banks.

More Posts