Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Brazil Presido Don Promise to Punish Anybody Wey Support Di Former Presido

January 10, 2023

Brazil President Luiz Inacio Lula da Silva don put hand for chest talk say e go punish anybody wey support the country former president, Jair Bolsonaro after dem storm Congress.

Plenty-plenty protesters wear the Brazil football shirts and flags con dey jaga-jaga the area and dis matter con dey happen just one week after dem welcome the new president. Supporters of the former president also storm waka enter the Supreme Court, con surround the presidential palace, but dem quick green-green the gsm of the National Guard pipo make dem come bring order to everywhere. The presido also order make dem close the center of the capital, including the main areas where the governmental buildings dey for 24 hours (1 day).

The former president, Mr. Bolsonaro don refuse accept say him lose last year October presidential election, and last week e no chook hand for the welcoming ceremonies wey suppose make am hand over the presidential belt as e run comot the country.

More Posts