Lagos State Government don talk say dem go close PWD rail crossing from Thursday, May 1, to make sure say commuters dey safe.
Lagos State Commissioner for Transportation, Mr Oluwaseun Osiyemi, yarn for one statement say make motorists use alternative roads like Ikeja or Airport road to reach where dem dey go. E still talk say di government take di decision to stop more accidents for di area.
Make we no forget say di crossing don turn place wey train and motor dey jam anyhow as dem dey try cross enter Ikeja and Maryland.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/president-tinubu-don-swear-in-ibas-as-di-sole-administrator-for-rivers-state/