Lagos State Government don talk say dem go redesign Oshodi Transport Interchange (OTI) to make am ready for Rail Mass Transit system integration.
Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, yarn this one for statement wey e drop yesterday. E talk say government go tackle the challenges wey dey affect Oshodi Transport Interchange as dem dey prepare to join am with the Rail Mass Transit system—especially the Red Line wey go connect with the Blue Line.
Osiyemi still talk say the ministry go do site visitation to check everything well, as dem wan make sure say Oshodi Transport Interchange dey work well as one important transport hub for Lagos State Mass Transit System.
READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/ig-of-police-don-warn-officers-make-dem-no-dey-do-unlawful-arrest-and-illegal-detention/