Kebbi State Governor, Comrade Nasir Idris, don send him condolences give him counterpart for Kaduna State, Governor Uba Sani, and also give Emir of Zazzau, Amb. Ahmed Nuhu Bamalli, sake of di sad collapse of mosque wey carry many lives. On Friday, plenty pipo bin dey di mosque for Zaria – wey dem believe say don dey over one century old – when e collapse during prayers.
For one press release wey di Chief Press Secretary to di governor, Alhaji Ahmed Idris, sign and release for Birnin Kebbi on Sunday evening, di governor talk say di event wey claim 12 lives na one tragic and big loss, no be only for Zaria and Zazzau Emirate, but e be loss for Kaduna State and Nigeria as a whole. E still send him condolences give di families of those wey lose their loved ones, and e also pray make those wey get injuries quick recover.