Kano State Pilgrims Welfare Board don sound serious warning give all people wey dey plan to perform 2027 Hajj, saying September 25 na the final bus stop for Hajj deposit payment and registration.

The board talk am clear say anybody wey no complete payment and registration before that date fit forget about getting Hajj seat, because no extension go dey.

Director-General of the board, Alhaji Abubakar Ibrahim-Matawalle, give the warning through statement wey the board Public Relations Officer, Sulaiman Dederi, release on Wednesday for Kano.

According to the statement, the board don peg ₦8 million as the official Hajj deposit for anybody wey wan perform the 2027 pilgrimage, and dem don urge all intending pilgrims make dem rush complete their payment and registration before the deadline reach.

The DG come make am clear say the board no get any plan to extend the registration period, and anybody wey fail to meet the September 25 deadline fit forget about getting Hajj seat for 2027.

According to am, setting a strict deadline go help the board plan well, arrange logistics properly and coordinate the entire Hajj exercise without any mix-up or last-minute wahala.

Ibrahim-Matawalle still reassure all intending pilgrims say the board don ready well-well to organise a smooth, transparent and wahala-free Hajj operation, so that everybody wey qualify fit perform dia pilgrimage without unnecessary stress or confusion.

He come advise all those wey dey plan to go Hajj make dem strictly follow every registration rule, submit all required documents and complete dia payment and registration on time, so dem no go lose the golden chance to fulfil one of the biggest and most sacred obligations for Islam.

FOR MORE TORI