JAMB don clear the air about admission rules as people dey complain say candidates wey score high no dey get admission.

JAMB don shift 2025 mock UTME go April 10

March 25, 2025

Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don shift di date for di 2025 Mock UTME from April 5 go April 10.

For dia weekly bulletin wey dem release yesterday, JAMB talk say dem change di date to make sure all necessary preparations dey complete, plus add new innovations wey go make di exam beta pass before.

Dem also talk say di rescheduling go help accommodate di increased number of exam centres. Candidates dem suppose dey watch out for announcement about di printing of dia Mock Notification Slip, wey go show di location of dia exam centre.

READ MORE RECENT NEWS HERE https://naija102.com/federal-government-don-launch-nigerian-youth-academy-niya/

More Posts